Jump to content
Volunteer with Us at Naijalez: Empowering Nigerian Lesbian Community ×
Nigerian Lesbian Forum

Shout Outs!!!


dequeen

Recommended Posts

Shout Out to all of una wey  never meet your friend girlfriend before, talk less of have tête-a-tête with her before but una done analyze her personality finish, dabaru her for your friend eye. Una dey try. Well-done.

Shout Out to all of una wey dey use anonymous section as liver transplant, as una no get liver air your views with una real username. Una do well.

Shout Out to all of una wey de shake tables for NL dey break things, una done give me brain, so I no sitdown for any table for here, make una break the tables if una like. Lwkmd. Well done.

Shout Out to all of una wey dey comment steady for NL, crude oil no go finish for your well. Una try pass, una do well. 

Shout Out to our admin dem , because they no dey ask us to pay dues for the hosting of this site. Pepper no go finish for their side. Una well-done.

Shout Out to all of una wey get girlfriends outside NL but still dey disturb man them pikins for this NL, una case dey apex court, we dey view you with 10d glass.

Shout Out to all of una wey dey carry NL do sexuality experiment, we understand. Nothing do you.

Shout Out to all of una wey dey try hustle build community for us outside this site, we done cram your name, e go enter history book. More grease to una elbow.

Shout Out to all of una wey dey carry outside beef con chop am for NL. Bless your appetite. Cock go grow teeth for una matter.

Shout Out to all of una wey dey investigate people post for NL to know who thief post and who no thief, una try, minister of research ma fit be office, we go give una.

Shout Out to all of una wey dey job people for airtime and data subscription here, we dey gather una file, na for inside river we go judge una case.

Shout Out to una wey dey carry people relationships gossip here and abroad, una own relationship wahala, na for CNN we go broadcast am.

Shout Out to all my baddest girls wey dey say I be good person, I know say una just dey try motivate me make I become good but I like am sha. One love.

Shout Out to all the saints for here wey don troway my file inside hell because I dey irredeemable, I dey hear una gist. Well done.

Make I go small break, in the mean time, NL-lers carry go o, throw una Shout Out. 

  • Like 2
Link to comment
Share on other sites

Mine own shout -out na to those silence members way just like to they read other people post but nor dey comment anything , una too much o, cos na that way sure pass naw.

Shout-out to those wan way der work na to dey hustle other babes girlfriends even though e clear for der eye say the babe dey inside relationship,  na God go punish this set of people.. 

Shout-out to dem girls way nor want drama, way even though beguiling things like " lesbian group watsap" carry their legs meet them,  Dem nor gree bulge, because they understand the kain things way dey hapun dere and nor wan involve themselves,  una be the real MVPs.. Twale for una abeg!

 

  • Haha 4
Link to comment
Share on other sites

  • Moderators

I absolutely like this. Thanks for this post.

Shout out to all you people wey believe in our online community. Wey dey participate to keep it active. Oil no go finish for your lamp. Una do well. 👌🏽👍🏽👏🏽

  • Like 1
Link to comment
Share on other sites

Hahahaha!

Shout out to you @dequeen for Eferytin wey you just yarn hia.you don finish mata be dat. 

Shout out to our Archbishop @kimi for steady sanctification Of NL. e no easy to tanda for this kin job,but all na for d love of the community. Carry waka,i dey ya back. 

Shout out to all de good people of NL. The ones wey only sabi to hatch evil, make una go collect una shout out from the Devil.

  • Haha 1
Link to comment
Share on other sites

Hahahaah Na WA 

Me sha dey throw way shout out to all them fine fine Otekus.

@kimi, even if you ask us to pay you for this your fine work. I no go hesitate. Especially if the payment na in kind 😉

 

  • Thanks 1
Link to comment
Share on other sites

Oh well, my shout out goes to them babes wey dey relationship but still dey hide them partners like say na unwanted pregnancy them carry.that kpekus wey una dey find,I pray make una nor find.

To them drama Queens, una own nor go trowey finish.Una matter still dey vault.We still dey look for key. Make una hold on,we go soon find the key.

To @FlyJ, babes o..my message don too sleep for your inbox,abeg try visit am.

I tuale give all of them admins. Una fish nor go ever miss for inside pot.

To all of us wey still dey singular😂😂. I dey shout out dey give all of una. May profit nor too run away from una business.

  • Haha 1
Link to comment
Share on other sites

  • 3 weeks later...

Shout out to all them broke beeches like me wey no allow intimidation enter us. We still dey proud of where we dey today! No be everybody wey dey do like say them no dey sheet really no dey sheet too. If you go some of them toilet ehnnn.....

 

Shoutout to the drama queens wey like to act feem pass Angelina Jolie, I pray say finally, them go fit hustle Oscar award for una oo.

 

To all the girls wey like to suck prick and toto at the same time, I pray make amadioha send shemale to una once and for all.

 

To all the ugly girls like me wey dey use photo wonder and snap chat filter, I pray say nobody go ever discover our secret ooooo. Make God no allow bad Belle pipu cash mark Zucker whatever abeg..

Ehen to all the girls with tight kpekus, una alum no go ever finish..

Link to comment
Share on other sites

  • 4 months later...
On 7/16/2018 at 12:16 AM, Excellent said:

Oh well, my shout out goes to them babes wey dey relationship but still dey hide them partners like say na unwanted pregnancy them carry.that kpekus wey una dey find,I pray make una nor find.

To them drama Queens, una own nor go trowey finish.Una matter still dey vault.We still dey look for key. Make una hold on,we go soon find the key.

To @FlyJ, babes o..my message don too sleep for your inbox,abeg try visit am.

I tuale give all of them admins. Una fish nor go ever miss for inside pot.

To all of us wey still dey singular😂😂. I dey shout out dey give all of una. May profit nor too run away from una business.

I miss you..here

It's a little lonely too..

Come O mother..

Mother plural..😁

I know you hate this but you won't see it anyway.. life is too short to not say my mind jaree😆😆

Link to comment
Share on other sites

Join the conversation

You can post now and register later. If you have an account, sign in now to post with your account.
Note: Your post will require moderator approval before it will be visible.

Guest
Reply to this topic...

×   Pasted as rich text.   Paste as plain text instead

  Only 75 emoji are allowed.

×   Your link has been automatically embedded.   Display as a link instead

×   Your previous content has been restored.   Clear editor

×   You cannot paste images directly. Upload or insert images from URL.

×
×
  • Create New...