Jump to content
Volunteer with Us at Naijalez: Empowering Nigerian Lesbian Community ×
Nigerian Lesbian Forum

If Awa Love Tori Enter Pidgin


Covfefe

Recommended Posts

Anytime I teh you say I sick

No look am say na malaria

Everytime I see you my eye dey shuck

Mai brain dey cut fuse like jalopy for area

Na you dey make my para dey meter

 

For my eye you be star geh,

Moon geh,

Everything for up dia wey catch eye

 

E do me high, do me low

Laik say na crase for market

Dis love thing na vibe

Wen your name enter e turn beta current

 

Rub the doubt comot like doti

Cos I see you well for light

You be am

Evritin I dey ask God for

And jara wey e put on top

 

Dem call me church geh e no pain

Cos I wan make you my bad habit

The original sin wey fit carry me go

 

Show face

I still dey wait for junction laidis.

 

 

  • Like 1
Link to comment
Share on other sites

Join the conversation

You can post now and register later. If you have an account, sign in now to post with your account.
Note: Your post will require moderator approval before it will be visible.

Guest
Reply to this topic...

×   Pasted as rich text.   Paste as plain text instead

  Only 75 emoji are allowed.

×   Your link has been automatically embedded.   Display as a link instead

×   Your previous content has been restored.   Clear editor

×   You cannot paste images directly. Upload or insert images from URL.

×
×
  • Create New...